fbpx
May 6, 2024

Mike Afolarin interview don expose how school drive am into acting

mike-afolarin-interview-with-Olamide-Famuwagun-

Mike Afolarin interview with Olamide Famuwagun don explain hin journey towards acting. Di role of Ishaya , for di Netflix series ‘Far from home’ na hin pipo don know am as.

Di Fast-rising Nollywood star tok say hin dey grateful for di opportunity wey hin get. Hin tok say plenty talented actors and actresses dey but as dem chose am to headline di amazing project, ‘Far from Home’, na something wey hin need to dey thank God for.

For Mike Afolarin interview, discussion about when he first start hin acting gig follow dey d table.

Hin tok say hin do di first acting gig for di year 2013 and na stage play. Di university wey hin dey go bin dey on six-months strike.

As hin no fit just sit down dey look, e kon go find something wey e fit dey do with hin time.

Na so hin see one audition wey e apply for. For di audition, dem tell am make hin play di lead na di first time wey hin go act professionally be that.

FOR MORE NEWS: Temi Otedola shock fans with her instagram post

Hin tok say before that time, hin don do other stage plays and dramas for hin church. As hin kon finish school, he decide say hin go enter di film industry, that one happen for year 2016.

Mike Afolarin interview comot plenty interesting gist. Di first Nollywood movie wey hin acte na for ‘Kasala.’ Before that time, e don do short films and telenovelas.

Hin mention legendary actors like Richard Mofe-Damijo, Gabriel Afolayan, and Funke Akindele, wey hin don watch a hin dey grow up.

Ishaya na one of di very interesting role wey hin play, he do plenty crazy things for di film,and na all those things make di roles interesting. But he tok say di role bin follow dey tasking.

You fit go read di full tori…READ MORE