fbpx
April 20, 2024

Kanye West don lose 2 billion inside one day because of Antisemitic comment

0
Kanye-West-.

American rapper and fashion mogul, Kanye West, don lost $2 billion in a day because of Antisemitic comment wey hin drop for hin social media handle some days ago.

If person dey anti-Semitic, e mean say di person dey wicked or partial against Jewish people.

“I’m a bit sleepy tonight but when I wake up I’m going death con 3 On JEWISH PEOPLE,” Na wetin di rapper write for hin tweet wey dem don delete now .

E neva too tey after hin post am, dem suspend di rap artist from di services of social media platforms like Twitter.

On top that matter, mega brands end dia deal with di rapper wey dey known as Ye. Hin long-time partnership with Adidas wey make am get up to billions, end because of di anti-Semitic comment.

YOU GO LIKE READ: Avoid These Top 10 visa Rejection Reasons

Di fashion giant write say Adidas no dey tolerate antisemitism and any kind of hate speech.

Hin yarn say di comments and actions wey Ye make no dey acceptable, and e dey hateful and dangerous. To put salt for injury, e violate di company values of diversity and inclusion, mutual respect and fairness.

As di matter be so, Kanye West don disconnect himself from Adidas and Adidas don comot am from the billionaire status.

Di tori dey inside DailyTrust…click here go read tori, e full ground…READ MORE

For more News:N100bn na hin i go collect from FG hand – Nnamdi Kanu

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *