fbpx
April 20, 2024

Seh na by force i tok say i no do again-Mohbad cried

0

Nigerian street singer,Mohbad’s lawyer don serve a notice of contract termination on i no do again to Naira Marley di owner of Marlian Records.

Mohbad wen shared one video clip early dis week for hin social media page, yarn say dem assault am for Marlian crew after him tok say him wan change him manager becos him don tire for the present manager wen hin get

U FIT ALSO READ Portable dey yeye graduates as hin count dollars after hin show for Italy.

Na dis reason make Mohbad lawyers on Tuesday issue Naira Marley’s Marlian Records label with immediate notice of contract termination.

Inside the letter di lawyer tok say na Naira Marley na him dey orchestrate violent attack on Mohbad through di martians family and also Naira Marley don failed to pay all royalties wen belong to Mohbad.

Di letter also tok say base on say Mohbad wan terminate him contract with Marlian Records,Naira Marley must pay all di royalties, advances, and all monetary compensation wen belong to Mohbad under di contract.

Ontop di same matter di letter still tok say make Naira Marley make sure say hin hands over to Mohbad di catalog of all hin songs wen he don released under Marlian Records.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *