fbpx
April 25, 2024

Kara/long Bridge hold-up: No be we dey responsible for una suffer – Ogun Govt

0

The Ogun State Government don come out on Monday to comot body for the number of hours wey road user dey spend for Kara/Long bridge on the Lagos-Ibadan expressway, that side if you dey enter Lagos side.

As those wey dey use the road don dey bad mouth Ogun- State government say nah dem be the cause as dem no repair the bad road.

Some motorists say nah the reconstruction work wey dey go on for the road be the reason wey motor no gree move for the road and that one no good for people wey dey go work and those wey dey do business for the side.

You fit still enjoy this article:  Use of Artificial intelligence in Education

When press people contact the Chief Press Secretary to Governor Dapo Abiodun, Kunle Somorin, he no make any sense to talk say nah Ogun State dey responsible for the hold-up wey make people suffer for the road. He yarn say the road nah Federal government road and nah dem dey do work on the road, say, Ogun State government even dey support the contractor with workers and security for night so that the work go dey fast.

The full tori tanda full grand inside tribune online…press the read more button to enjoy the full tori READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *