fbpx
May 8, 2024

Peter Obi storm Supreme Court To Nullify Tinubu Election

obi-file-appeal-for-supreme-court

Di presidential candidate of Labour Party (LP) for di last election, Peter Obi, don file appeal on 51 grounds for Supreme Court.

Former Anambra State governor tok say hin no agree with di ruling of Presidential Election Petition Tribunal, wey dismiss hin case.

Also, you fit remember say Obi bin go meet Tribunal dey ask dem say make dem declare am di winner of February 25 Presidential Election.

 

FOR MORE NEWS: 12.5kg cooking gas price fit hit N18,000 December

 

Di Independent National Electoral Commission, INEC, bin declare Bola Tinubu, wey be di presidential candidate of di All Progressives Congress, APC, as di winner of di polls.

However, Peter Obi and Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party, PDP, dey challenge di declaration of INEC for court.

As di tribunal support di victory of Bola Tinubu, both Obi and Atiku don vow to seek justice for di apex court.

But Peter Obi don file hin petition for di Supreme Court.

Obi don file appeal for Supreme Court, You fit go read di tori…READ MORE