fbpx
April 26, 2024

I tell my mama make she no sell friut again after I get deal with Mavin. – Crayon

0
Mavin\records\latest\signee\crayon\drops\debut\project\cray\cray

Mavin records latest signee crayon don drops debut project cray-cray.

 

Afrobeat musician wey dem dey call Crayon talk as im music career help am comot poverty for im family.

 

Crayon don reveal say  he stop im mama from selling fruits for  Iyana Oba market after dem signed am to Baby Fresh’s Blowtime Entertainment,  imprint of Mavin Records.

 

He talk about how he don sacrifice school focus for music and how the decision don help am well so tey, e fit ft take care of im mama and papa.

Crayon mama bin dey sell fruits like carrot and cucumber but she don stop now. As he get the deal for year 2019, he tell himself say im mama no go suffer again.

One day he call im mama wey bin dey market dey sell,  send money for her, on tell her say make she dey go house. 

The mama kon tell am say, “but I dey market dey sell”. I know mama, just leave am go house. Na wetin he tell her be that.

 

You fit also enjoy this one: Netflix series- Alchemy of Souls(Kdrama)

 

She bin no wan free, but later later she stop the market wey she dey sell.

 

Remember the time wey he promised im mama say he go comot her for poverty. Now he don do am and the thing make am happy. This na wetin e don get for mind and e happen.

 

This musician talk say im family don dey support the music wey he dey do and na for 2016 he get im first record.

He get time wey the papa ask am whether he dey sure say na wetin he wan dey do be that, na im the man follow pray for blessings for am.

 

To read more of this tori, CLICK HERE.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *