fbpx
April 27, 2024

Kwankwaso go beat Atiku,Tinubu hands down for dis coming 2023 election – NNPP Chairman

0

Chairmo of New Nigeria People’s Party (NNPP), Alhaji Ahmed Tijjani, tok say, Sen, Rabi’u Kwankwaso go beat Atiku and Tinubu in di 2023 general election.

Him yarn dis one with News Agency of Nigeria (NAN) on Sunday inside Kaduna.
“wetin our party don achieved in three months of existence, both di APC and di PDP no fit achieve am in one year.

With di way di masses accept our party,e don show say nothing go stop us from winning di 2023 general election.

U FIT ALSO READ Ortom,and gang una too small for me to deal with – Ayu

Tijjani tok say unlike other presidential candidates, Kwankwaso get enough achievements to show in his previous leadership positions in di country.

Di chairmo tok say di PDP and di APC don fail Nigerians in all aspects,therefore dia party wan takeover di leadership of di country.

Our party NNPP go win dis coming 2023 election, if him dey lie make hin bath naked for bathroom.

Di masses don dey ready to vote for beta candidate with proven integrity in respective of how big dia parties be wetin go happun go happun.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *