fbpx
May 8, 2024

NLC strike: Pack food keep for una house – Labour Party tell supporters

labour-party-advise-supporters

Di Labour Party don advise dia supporters across di kontri say make dem stock dia house with necessary items ahead of di proposed indefinite strike by organized labour.

Also, report tok say Nigeria Labour Congress, NLC, and di Trade Union Congress, TUC, fit shut down di kontri economy on October 3 to press home dia demands for better working conditions.

Inside a statement wey National Publicity Secretary, Obiora Ifoh, issue on Wednesday, di Labour Party leadership declare support for di proposed indefinite strike.

 

FOR MORE NEWS: FG must address the increase for cooking gas price —NALPGAM

 

According to di party, President Bola Tinubu administration no care about di hardship wey di nation dey face following di removal of fuel subsidy.

Also, di party lament say di economic reality of di kontri donlead to withdrawal of some students by parents wey no fit pay dia children school fees.

Part of di statement read say Nigerian workers don show enough patience and understanding. Also, dem dey use di medium inform all dia members and supporters say make dem stock dia house with necessary needs, ahead of di long-drawn mass action until victory dey sure.

Labour Party advise supporters, You fit go read di tori…READ MORE