fbpx
April 25, 2024

Labour Party don promise to give Nigerians N80,000 minimum wage

0

Di Labour Party don promise to implement minimum wage of N80,000-N100,000 to all Nigerians if dia presidential candidate, Peter Obi win next year presidential election.

Di party Deputy National Chairman, Ayo Olorunfemi yarn dis one during one interview ontop Channels Television’s Sunrise Daily on Thursday.

U FIT ALSO READ Niger lawmakers advise govt make dem offer automatic employment to N-Power beneficiaries

Olorunfemi tok say di party bin don dey plan to increase di current minimum wage from N30,000 to range of N80,000 and N100,000 while making dia manifesto.

Some days back, di Labour Party unveil dia manifesto where Obi don push di agreement to dey pay hourly wages for all Nigerians against di current monthly salary for di countri.

Di LP chieftain tok say if a worker dey collect about N1,000 per hour in a job, he or she go fit boast nothing less than N4,000 per day, and dis one fit make di employee dey earn beetwin N80,000 and N100,000 per month depending on di nature of di job.

Wen dey say make hin further clarify hin comment, di LP chieftain maintain hin stand say dia party dey eye up to “N80,000-N100,000” as a new monthly minimum wage, na di exact place where dem dey go bi dat.”

Olorunfemi tok say di present N30,000 minimum wage no reach Nigerian workers again with dia present realities. and Labour Party go ensure say di new minimum wages structure is implemented if di party wins di next year election.

Olorunfemi tok say everybodi kukuma know di amount of oil dey rise on daily basis just becos of some oil theft wey dey carry our oil go anoda countri go dey sell and at di aame time pack the oil money go hide for dia toilet,”

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *