fbpx
April 24, 2024

Niger lawmakers advise govt make dem offer automatic employment to N-Power beneficiaries

0
N-Power

Members of di Niger State House of Assembly don advise di State Government make dem give qualified N-Power Beneficiaries automatic employment for di on- going staff recruitment exercise.

Di house take di decision following di motion by Haruna, di member wey dey represent di Bida two constituency for di floor of di house.

Di lawmaker bin mention say di N-Power beneficiaries don gain experience from di work wey dem dey do as dem dey undergo di programme. No be only qualification dem get.

YOU GO LIKE READ: Online Marketing Guides for Pharmacists

According to wetin hin talk, automatic empowerment for di ongoing recruitment exercise go help bring better hands on board for di state.

“This na because N-Power programme dey designed to assist Nigerian youths make dem fit develop life-long skills to become change-makers for di community and to address issues of unemployment”.

This tori dry inside Dailypost…READ MORE

For more news: FG don recover at least N120bn from crime proceeds —Lai Mohammed

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *