fbpx
May 18, 2024

“I did not see the need to announce what had not been formalized in God’s presence yet” – Leo DaSilva don explain why hin engagement dey lowkey

leo-dasilva-engagement

Big Brother Naija star, Leo Babarinde DaSilva, don reveal why hin decide to keep hin engagement as secret.

Remember say some days before, hin raise speculations about hin marital status when hin make tweet to explain how he make hin pipo agree to lowkey wedding.

As Leo DaSilva dey tok for interview about hin engagement, hin reveal say e believe firmly for person to marry before dem start to bring children into di world.

He yarn say he dey engaged. However, hin no see di ned to make am public because hin go announce am when he don marry. Also, he yarn say he no see di need to announce wetin neva dey formalized for God presence.

When dem ask am wetin hin no fit do for relationship, Leo yarn say e go be do dey born children.Also, na hin own thinking be dat. Some pipo fit prefer to do am di other way too. But hin just prefer to do am when hin don married.”

Leo add say hin no go regret anything about bachelor living once he don marry.

Also, Leo claim say hin for don marry when he dey much younger if to say hin parents still dey alive, but he put am one side to get hin life in order.

FOR MORE NEWS: Hackers allegedly steal N2.9bn from Flutterwave

in addition, hin tok about lessons wey he don learn from being in a relationship. Leo yarn say di most important lesson wey he don learn na patience. Also, person no fit  dey with person wey no dey. 

You fit go read di full tori…READ MORE