fbpx
May 5, 2024

Long Queue for Benue as fuel enter N300/Litre

long-queue-for-benue-as-fuel-enter-n300-litre

Long queue for Benue as fuel enter N300/Litre on Sunday, motorists no happy with how e dey to buy fuel, di petroleum product dey hard even as di price don increase.

Di PMS (petrol) wey dey available for most filling stations dey between N295 and N300 per litre while black market na reach N350 and N400 per litre.

According to report, long queues for fuel dey for NNPC Filling Station along Otukpo road for Makurdi, A. A. Rano for Wurukum roundabout and for di Rain Oil Filling Station along Modern Market road for Makurdi metropolis.

Some of the motorists yarn say dem don wait for more than three hours and dem neva see fuel buy for dia vehicle because e neva reach dia turn.

FOR MORE NEWS: Electricity Spark Kill Family Of 4 for Zaria

Awusa Bobby tok say hin join di long queue for  Rain Oil for over three hours and hin neva buy fuel for hin car.

Olije Jerome, wey follow queue for di NNPC Filling Station, yarn say di fueling station get fuel and dem dey sell am for normal government rate, but because of  di long queue, e neva reach hin turn.

Another report tok say fuel stations for Makurdi, di state capital, no sell fuel, dem claim say  dem no get di petroleum products.

Di fueling station wey get small queue for dia yard dey charge customers N300 per litre while others with longer queues apart from di NNPC, A. A. Rano and Shafa filling stations wey dey dispense at N190; sell dia own between N260 and N280.

This Long queue for Benue as fuel enter N300/Litre no make pipo happy at all, e for better if dem even fit buy di fuel comot for fueling station.

You fit go read di full tori…READ MORE