fbpx
April 25, 2024

Mr tax collector, no use tax kill di pipol of Anambra – HURIWA warn Soludo

0

Human Rights Writers Association of Nigeria, HURIWA, don warn di Governor of Anambra State, Chukwuma Soludo over hin ‘taxation regime’ for di state
According to HURIWA,dem tok say dat mindset wen Soludo get and di yeye policy wen hin wan dey apply like CBN give di pipol of Anambra no go fit work oo

HURIWA, yarn dis one through dia National Coordinator, Comrade Emmanuel Onwubiko, hin tok say,instead of make Soludo dey think on how di state economy go yield more profit, na so so pay your tax na hin Soludo dey tell di pipol of Anambra.

U FIT ALSO READ No-work-no-pay policy if e easy you self run am – Sowore clear Buhari

why hin go dey force di pipol of Anambra to pay for more tax,seh hin no know say e fit lead to high level of poverty for both Anambra and di whole of southeast pipol.

HURIWA tok say since di inauguration of Soludo on March 17, 2022, di former CBN governor don introduce different kind of taxes on di poor pipol of Anambra,abi seh Soludo think say Anambra na CBN wen hin dey control dat time.

Onwubiko tok say, “ why Soludo go dey target di poor pipol with hin yeye taxation regime policy,instead of him to face di rich pipol wen don chop belle full and still get more than enough for dia pocket.

HURIWA group don tok say make Governor Soludo no dey compare Anambra state to Lagos state to justify di kind tax wen hin go impose on di pipol of Anambra, fish and crayfish no bi di same thing ooo‥

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *