fbpx
May 4, 2024

Man hire hin friend for N10, 000 make hin kill hin pregnant wife for Ogun

Eluyera-killed-pregnant-wife

Police wey dey Ogun state don arrest one 35-year-old man identified as Eluyera Wasiu because hin plan with hin friend, Adeniyi Samuel, to kill hin 29-year-old pregnant wife.

Di spokesperson of di state police command, SP Abimbola Oyeyemi wey confirm di thing wey happen, yarn say dem arrest di suspect and hin accomplice following di distress call by di DPO Ogijo Police Division for Sagamu Local Government Area of di state.

Hin mention say di police get information from concerned members of di public on January 2, say di two men bin dey engaged in serious fight for Oponuwa Area of Ogijo wey fit lead to grievous injury or death if dem no dey separated.

FOR MORE NEWS: My Boyfriend leave me becos say i act bedroom scene — Mellisa Osagie

As police dey ask dem question, Adeniyi Samuel yarn say na Eluyera Wasiu pay am money make hin kill hin pregnant wife, one Bola Taiwo.

Di thing wey kon bring fight na di balance wey Eluyera no gree give hin friend for di job wey hin complete.

You fit go read more of this tori…READ MORE