fbpx
April 24, 2024

We don recover up to $1bn looted funds since 2015 —FG

0

Di Federal Government as at yesterday tok say dey don recover up to $1 billion, looted funds, since di beginning of President Muhammadu Buhari’s administration till date.

Di Attorney General of di Federation, AGF, and Minister of Justice, Abubakar Malami, bin yarn dis one to tori pipol for presidential villa at di end of di weekly Federal Executive Council, FEC, meeting way bin sele for Abuja.

U FIT ALSO READ Dollar crisis: EFCC dey plan serious raid for forex dealers

President Buhari for di Council Chamber, tok say all di money and assets way dem recover, dey don share am to various sectors of di economy, even poverty alleviation self join.

Di AGF, tok say federal government don record up to 109 convictions bifore 2015, hin con still yarn say di Buhari administration don convict over 3,000 offenders and dey don recover about $1b up till date.

Malami tok say FG bin dey very concern over di cases of budget padding and magomago, hin tok say dat thing no good at all.and dem self don dey try to make sure say everything dey in order.

Di council don approve new anti-corruption strategy document to strengthen anti-graft fight for di countri,which di programme go last from 2022 till 2026.

Malami tok say na di anti- corruption initiatives na hin help di government to recover about $1billion money wen pipol thief from government con go hide.

Hin tok say “ di new anti- corruption strategy go even strengthen di war against corruption beetwin 2022 and 2026.“

According to questions wen tori pipol ask on budget padding mattar, malami tok say di federal government bin don dey study every details of di budget, and dem go try sought everything out very soon.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *