fbpx
March 19, 2024

Japanese billionaire Masatoshi Ito don kpai at 98

masatoshi-ito-don-kpai-at-98

Tori don come out say Japanese billionaire Masatoshi Ito don kpai at di age of 98.

Di Japanese billionaire Masatoshi Ito wey kpai at age 98 bin turn 7-Eleven convenience stores into a global empire, hin close di chapter on one of Asia most storied retail entrepreneurs.

Operator of 7-Eleven, Seven & I Holdings, announce hin death inside statement on Monday.

“We would like to express our deepest gratitude for your kindness and friendship during his life and respectfully inform you of his passing,” Na wetin di company tok be dat.

FOR MORE NEWS: Why I always change my mind after I decide to leave my husband, Ned Nwoko – Regina Daniels don open up

Ito transform everyday retail for Japan, he turn US-born company into an international brand, particularly for Asia where 7-Eleven shops dey rarely more than a few minutes’ walk away  for plenty cities.

Seven & I Holdings now don get over 83,000 stores around di world, including 7-Eleven shops for 19 regions and countries.

You fit go read di full tori…READ MORE