fbpx
May 4, 2024

Messi don collect offer deal worth £1 billion to join new club

messi-collect-offer-worth-1-billion

Messi collect offer worth £1 billion.

New report claim say Lionel Messi don collect offer of two-year contract deal worth €1 billion (£887m), to Saudi club.

According to di French newspaper, L’Equipe, di monstrous deal, if dem sign am go worth double of wetin Cristiano Ronaldo dey earn for Saudi side Al-Nassr.

L’Equipe follow drop di details of how much di ‘exceptional’ offer wey dey on top di table go worth for Messi. Dem claim say na totals of €1bn over two seasons, with di option of a third.

 

FOR MORE NEWS: Real Madrid legend advise Messi against returning to Barcelona

 

Messi future for Paris Saint-Germain dey under radar following hin suspension for an unauthorised trip to Saudi Arabia for a commercial deal.

You fit go read di tori as Messi collect offer worth £1 billion …READ MORE