fbpx
March 29, 2024

“Millions don go” – Man dey cry as all hin money wey hin save for piggy box don decay

0
piggy-box

One Nigerian man don dey in pain after hin open hin metal piggy box bank with di hope say hin go carry am go deposit for bank, , only to discover say di money don decay.

E dey obvious say hin don dey keep cash for inside di box and go dey expect say hin go see plenty money when he finally open am.

E no too tey wey hin carry di piggy box go bank so that hin go open am there, but regrettably, all di money inside don rotten.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

E get video wey dey make rounds for internet, di video show di rusty piggy box and di naira notes wey don decay as dem dey transfer am to another bag. Bank employeesfollow dey examin di bad notes and dem sef bin dey feel sorry for di man.

You fit go read more of this tori…READ MORE

For more news: Dem get agenda wey dem dey hide – Mixed reactions don follow CBN new naira notes

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *