fbpx
March 28, 2024

System don break down, as airlines dey issue ticket manually for Lagos Airport

0

International travellers for Muritala Muhammed International Airport, MMIA,currently, might not bi able to travel out of di countri.base on top one or two alignment for di airport.

Dis na becos di lagos airport bin get issue with dia backdrop for system break down.

U FIT ALSO READ Nigeria carry 1st position among other countries for Cannabis mattar — Buba Marwa

According to tori di airport as at now dey force airlines to issue dia air tickets manually.

Dis gbege wen bi happun so, don hinder some pipol way wan travel to access dia boarding pass, and if dem no take time most of dem go miss dia flight.

Most of di travellers don dey para on top di situation, while some don dey fear con dey call on di airport authority to come explain wetin dey sup.

According to one traveller. Hin yarn tori pipol on di development, say di Federal Airport Authority of Nigeria, FAAN, lack di competence on managing the airport system.

Hin tok say: “ hin bin dey disappointed. Why FAAN go dey exhibit such level of incompetence.make dem see as di que plenty.

Him still tok say most of dem go surely miss dia flight today. dem no even fit generate boarding pass give dem from dia system, like dis like dis na manual format dem dey use take attend to dem.

FAAN need to find solution as soon as possible.abi why hin go dey pay additional money for change of flight date.

According to Acting General Manager, Corporate Affairs, FAAN, Mrs. Faithful Hope-Ivbaze, she tok say “True True di airport dey system downtime currently and she self no fit tok say na wetin cause am bi dis but make pipol no worry dia engineers don dey wprk ontop am to put everything in order

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *