fbpx
September 16, 2024

“Anambra student Ejikeme Mmesoma forge her UTME result” – JAMB spokesperson don reveal

JAMB-spokeperson-tok-say-mmesoma-increase-her-result-

Di Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) don stand dia ground on top di trending matter wey dem tok say Anambra student, Ejikeme Mmesoma, increase her result for di 2023 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Also, di board, inside statement wey dem release on Sunday, July 2nd, announce say Mmesoma, a student of di Anglican Girls Secondary School, Nnewi for Anambra State, increase her result and she falsely proclaim herself as di top scorer for di 2023 UTME.

According to JAMB, Mmesoma real score for di examination na 249, contrary to di 362 wey she dey claim.

However, inside video, di girl deny say she forge her result, and she yarn say di allegation against her by JAMB don make her traumatized.

 

FOR MORE NEWS: JAMB vs Mmesoma controversy don show say 2023 elections divide Nigeria – Omokri

 

Upon say Mmesoma dey tok say she no forge her result and say di result na wetin she print from JAMB official website, Fabian Benjamin, di spokesperson of JAMB, repeat am for interview with Leadership say no candidate score 362 for di 2023 UTME.

Di JAMB spokesperson claim say Mmesoma edit person result and she start to parade herself as di highest scorer of di 2023 UTME.

Also, hin claim say di design of di result wey dey with Mmesoma dey different from wetin JAMB use for di 2023 UTME candidates.

You fit go read di tori see di tori as Mmesoma increase her result…READ MORE