fbpx
April 26, 2024

Morocco don launch 30 extra flights to jet fans go Qatar 2022 World Cup

0
Morocco-world-cup
Morocco players celebrate with their supporters after dem win di Qatar 2022 World Cup quarter-final football match between Morocco and Portugal for di Al-Thumama Stadium for Doha on December 10, 2022. 

Morocco national airline don reinforced with 30 extra return flights to jet jubilant fans go Qatar for Wednesday’s historic World Cup semi-final against France.

For inside statement on Monday, di firm say, “In order to allow di plenty Moroccans wey wan support di national team at its peak and experience di emotion of di World Cup semi-final, Royal Air Maroc don set up air bridge between Casablanca and Doha.”

YOU GO LIKE READ: Online Marketing Guides for Pharmacists

You go remember say Morocco beat Cristiano Ronaldo Portugal 1-0 on Saturday, e make dem become di first African or Arab team wey go qualify for World Cup semi-final and e spark celebrations across di Arab world.

Di North African kingdom airline call am historic qualification” and dem yarn say jumbo jets go operate di 30 return flights on Tuesday and Wednesday in time for di match.

This tori dey inside Vangard…READ MORE

For more news: Qatar2022: History don set himself as Morocco beat Portugal  to qualify for semi-final

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *