fbpx
April 26, 2024

Qatar 2022: Modric dey blame one person after Croatia semi-final 3-0 loss to Argentina

0
Luka-Modric.

Croatia midfielder, Luka Modric, don blame referee Daniele Orsato following di World Cup semi-final 3-0 defeat to Argentina on Tuesday night.

Modric claim say Orsato no award Croatia a corner and a penalty during their tie with Argentina.

One goal from Messi and a brace from Julian Alvarez na him give Argentina di victory over Croatia for di Lusail Stadium.

FOR MORE NEWS: Morocco don launch 30 extra flights to jet fans go Qatar 2022 World Cup

Hin yarn say e no suppose be like that but them need to recover and try to win di match for third place.  “We dey sad, we bin wan enter final. We go congratulate Argentina,” Modric yarn this one for hin post-match press conference.

Di Real Madrid star add say dem dey fine, controlling di game and di corner wey di referee no give dem and the penalty.

This story dey inside Daily Post…READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *