fbpx
April 26, 2024

No-work-no-pay policy if e easy you self run am – Sowore clear Buhari

0

Di presidential candidate of di African Action Congress (AAC), Omoyele Sowore, wen hin dey yarn on top one mata beetwin di Federal Government and Academic Staff Union of Universities (ASUU), hin tok say ‘no work, no pay’ policy on University lecturers suppose start from President Muhammadu Buhari

Sowore, wen bin show hin self for di presidential town hall debate on Friday evening, tok say if FG won use strong head enforce di ‘no work, no pay’ policy, make e first start from Buhari becos hin no see any work wen Buhari dey do.

U FIT ALSO READ UNIBEN lecturer use big grammar break FG head over ASUU strike mata

Hin tok say “wen workers go for strike na di responsibility of di government to pay dem becos no bi dem go bi dem self na di government force dem to go for strike..

Sowore tok say if FG feel say hin no go pay di pipol wen no work hin believe say na di President go bi di number one to start am becos him no see any work wen di President dey do.

Our higher institutions too dey important pass say make some pipol con dey play with am.

Hin tok say if ASUU dey ask for any money.make FG find am for dem,dia demand na di same thing since 1990s abi why government dey do like dat

.To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *