fbpx
March 28, 2024

My red bra don give me money pass university degree – Actor, Uche Maduagwu

0
Uche-Maduagwu.

Controversial Nollywood actor, Uche Maduagwu, wey dey known for making Instagram content with bra, don reveal how hin make millions from wearing bra.

Di actor, for post wey hin share for hin Instagram page, talk say hin university degree never give am di kind of money wey hin dey make from di bra we hin dey wear.

Uche advise hin followers say make dem focus on anything wey dey bring genuine source of livelihood, e no matter how shameful di world make am resemble.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

As hin dey encourage Nigerians make dem dey consistent with anything wey dem dey do, Uche reveal say di bra content dey pay hin bills despite di talk wey hin dey receive from haters.

Na wetin hin yarn be this: “I have made a lot of money with my ‘RED BRA’ than what my University Degree has ever given me. My management said I should not say this, but I make million wearing the Red Bra. Some of you are busy making jest and criticizing me while I smile to my BANK every week.’

This tori dey inside Dailypost…READ MORE

For more news: DJ Cuppy Show off big Gold Ring Some Days After Her Engagement

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *