fbpx
April 20, 2024

“Thunder go locate you if you no stop this rubbish” – Yemi Alade don fire back to troll wey call her songs ‘nursery rhymes’

0
yemi-alade

Na serious exchange of words na hin dey happen between singer Yemi Alade and troll wey lower her music for microblogging platform, Twitter.

Di drama start after her junior colleagues, Buju BNXN and Ruger, dey fight for di umpteenth time over who get more hit songs.

As dem dey fight, Ruger accuse BNXN say hin pay big amount of money to promote hin songs even though people no like di songs.

Di talk make BNXN vex, na so hin follow accused Ruger record label boss  say dem dey ‘streaming farms’ to increase hin numbers on music streaming platforms.

Another singer follow react, Blaq Bones, enter di conversation. Hin say, “all of una wey dey use streaming farmsgo dey exposed soon. awon hushpuppi”.

YOU GO LIKE READ: 9 Soft Skills Workers Need In The Workplace

Na for here Yemi Alade sef follow put mouth for si discussion.Na wetng, “Never saw a ” realler ” tweet! Somebody pls frame this tweet for me. I want to hang it on my wall.”

But di ‘Mama Africa’ enter serious clash with troll wey criticized her songs, hin call them ‘nursery rhymes’.

“You can try writing good hit songs and not your nursery rhymes”, na wetin di troll write be that.

This tori full ground, you fit go enjoy more of di gist…READ MORE

For more news: My red bra don give me money pass university degree – Actor, Uche Maduagwu

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *