fbpx
April 24, 2024

Na True Gunmen Carry Nasarawa State Commissioner – Police

0

Di police command wey dey Nasarawa state don confirm am sey na true true gunmen carry Nasarawa State Commissioner for Information, Culture and Tourism, Yakubu Lawal join body.

Na di police public relations officer ( PPRO ), DSP Ramhan Nansel confirm di matter for one talk wey dem carry give tori people for Lafia wey be di state capital today.

YOU GO FIT LIKE READ: Oga Presido, Increase Salaries Nau! –  NLC Yarn Buhari

According to Weytin di PPRO talk, na for yesterday evening dem call di attention of di police wey dey patrol routine sey make dem hear how gunmen take Dey shot for Nassarawa-Eggon Local Government Area of di state.

Di commissioner of police, Adesina Soyemi wey dey di state kon yarn di policemen, Police Mobile Force, di Anti kidnapping unit, Military personnel, Vigilante and local hunters sey make dem stand on top deir to e and open eye down to carry di gunmen like chicken.

He kon add am join sey dem go make sure sey dem collect di commissioner down for gunmen hand and unhurt and also catch di people wey use di commissioner do handbag go.

Di PPRO kon talk for di commissioner of police sey any better Samaritan wey get any aproko wey dem go fit use see di commissioner abi knw where he dey, sey make dem yarn di police on time.

YOU TOO CARRY EYES SHOOK! READ MOTE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *