fbpx
March 29, 2024

Oga Presido, Increase Salaries Nau! – NLC Yarn Buhari

0

Di Nigeria labour congress don write give presido, Sey make he add berekete money on top all di people wey dey hustle salary.

Di congress talk Sey make di president put 50 percent on top every worker salary.

YOU FIT LIKE TO READ: We No Go Allow Lawan Block Buhari Sacking – Who Talk Am? – Senator

Di decision show face after the group wey dem dey call Nigerian Governor’s Forum follow Buhari talk sey make he comot di subsidy wey dey on top petiro, kon add am join sey make di president tell all di people wey dey work wey deir age don reach 50 go deir mama house go rest.

Di forum kon talk go front Sey, if president go fit follow Wetin dem dey follow am talk, Sey di hunger and suffer suffer wey dey dis country go komot sharperly.

Na all dis thing wey di Nigeria labour congress hear na hin come make dem stand up Sey make president no hear Wetin di Governor’s forum dey follow him talk, Sey di talk no be better talk at all.

Dey kon follow Buhari talk like padi Sey make he add 50 percent on top all the people wey dey work salary. WE KNOW SAY YOU GO WAN READ DI TORI, OYA SHOOK EYES! READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *