fbpx
March 29, 2024

Na why Nigeria Be My Biggest Fear Be This – Kemi Afolabi

0
Kemi-Afolabi.

Popular Nollywood actress, Kemi Afolabi, don reveal how happiness diappear from her heart as she enter Naija from United States.

She don travel go U.S. since July for her lupus treatment, and she finally enter Naija after di successful treatment.

Kemi, wey bin don described Nigeria as her biggest fear, she claim say nothing don change since she comot for di country.

On top her verified Instagram page, she yarn some tori: “Back to my biggest fear…my country NIGERIA. Nothing has changed! Same Nonnie.

She say as dem land for Airport, na correct hot weather na hin greet dem. Na so she quickly comot her top tie am for her waist, and she rock her camisole with pride ehn! She still yarn say Them no they tell person, body go tell you.

Afolabi bin don announce for March say she dey diagnosed with systemic lupus erythematosus (SLE) also known as Lupus last year. She follow yarn say her doctor talk say na 5 years she get to live.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *