fbpx
April 25, 2024

Singer Skales Advise say make pipo no go marry person wey no get heart.

0
Skales-Pic

Popular Nigerian singer, Raoul John Njeng-Njeng born on April 1, 1991, wey pipo know as hin stage name Skales, don give hin  two cents on marriage. 

Di Shake Body singer wey recently tie di knot with hin model wife, Hassanity, don advise say make pipo no go marry partner wey dey heartless.

Di singer Skales wey just lose hin mama go hin Instagram stories ask hin two million followers make dem pray for hin mental health as he reveal say hin be  orphan and he want make him mama come back. 

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

For series of hin posts, di singer write, “A solid female means a lot to a man who can trust nobody. “In all you do, make sure you don’t marry a heartless person. Pray for my mental health.

For hin Instagram story, hin share photo of himself and hin mama. But some update reveal sy di singer don unfollow hin wife for Instagram.

Di full tori dey inside Dailytrust…click here go read di remaining tori…READ MORE

For more News: Mavin album go soon hit market-Don Jazzy

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *