fbpx
March 29, 2024

“Na your ancestors you dey snub, no be me” — James Brown slams Bobrisky because hin no acknowledge hin greeting

0
James-brown-Bob-Risky

Nigerian crossdresser, James Brown don lambast hin senior colleague, Bobrisky because hin fail to acknowledge hin greeting for one event.

Di two of them with popular influencer, Papaya, be guests for on event di previous night and as dem meet for one location, e almost turn to serious fight.

For inside video wey dey trend online, di self-styled Princess of Africa bin dey dance with Papaya, near where Bobrisky bin sit down.

YOU GO LIKE READ: 6 Business Ideas in Nigeria to Start with Little Capital

But later, e kon be like say Bobrisky no dey comfortable as dem dey dance near where hin dey, na for there wahala start.

Dem see as hin bin dey use hin hands dey explain say enough space dey for di venue and make dem no come near hin direction.

As everything happen like that, James Brown kneel down in front of Bobrisky. E be like say hin bin wan greet am or apologize to am for di disturbance but Bobrisky no take am like that.

You fit go enjoy more of this tori, e full ground…READ MORE

For more news: Nkechi Blessing visit Ooni of Ife, fans react

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *