fbpx
June 26, 2024

Celebrities don attack Nedu over hin comment about BBNaija female housemates

nedu-comment-about-bbnaija-female-housemates-don dey-disturb-celebrities

Popular Nigerian comedian, Chinedu Ani Emmanuel, aka Nedu don stylish tok against Big Brother Naija BBNaija female housemates, and e don continue to disturb di entertainment industry.

Nedu for hin interview with BBNaija ‘Level Up’ housemate, Doyinsola David, for hin podcast ‘The Honest Bunch’ claim say most female housemates for  BBNaija reality TV show dey go because dem wan get customers (na sex hin refer to), hin insist say dem no get anythings else to offer other than dia body.

To Further support  hin point, Nedu claim say di reality show get way of putting pipo for limelight but with no substance to maintain aam.

“Na only sex many of them get to offer. Dem  dey intentionally go there just to get customers,”Na wetin Nedu tok be that.

In response, Doyin yarn say e dey normal for human nature to find greener pastures and “customer” sef fit turn to husband.

FOR MORE NEWS: “After you don scatter my ….” – Mercy Eke Tell Actor Chidi Mokeme For Inside Goofy Video

Additionally, Doyin still argue say  nothing wrong dey wrong if di ladies go di show simply for that purpose.

This all allegation dey come a week into di commencement of another BBnaija series. Di show na combination of both Nigerian and South African housemates, dem tag am ‘BBTitans’, and di winner go get $100,000 (over N50,000 million).

However, di statement no go well with most of di show stars. Many Big Brother Naija celebrities don come out defend dia female colleagues over di verbal attacks.

In reaction to this matter, former BBNaija Season 6 star, Angel Agnes Smith for inside tweet, accuse men osay dem dey jealous of hard-working women wey dey di show.

Former BBNaija housemate, Abiri Oluwabusayo, wey dem dey call  Khloe, follow blasted Nedu over hin comment. She yarn say hin actions show why hin ex-wife allegedly cheat on am.

You fit go read di full tori…READ MORE