fbpx
May 4, 2024

Subsidy removal: NEITI go investigate di controversial 66.8m litres daily fuel consumption figure

neiti-to-investigate-fuel-consumption-in-Nigeria

Di Nigeria Extractive Industries Transparency Initiative, NEITI, don dey take steps to investigate di consumption volume of fuel, aka Premium Motor Spirit, wey dey popularly known as petrol, for Nigeria amid di hardship of fuel subsidy removal.

Na di Executive Secretary, NEITI, Ogbonnaya Orji, reveal dis tori for Abuja on Tuesday as hin dey follow journalists tok on di sidelines of di Stakeholders Validation Workshop on di 2022 Annual Progress Report for Nigeria Extractive Industries.

He yarn say di projected daily fuel consumption fit dey less than wetin dey presented.

Hin yarn say dem believe say di figures of di daily consumption of PMS for Nigeria no correct. So, dem practical figure, so NEITI dey commission research on di actual PMS consumption for Nigeria.

 

FOR MORE NEWS: Naira appreciate against dollar

 

In addition, hin yarn say dem get every reason to believe say di figure fit dey less than wetin dey projected, and di removal of subsidy don follow remove all di incentives for hiking di figure in a manner wey lack practical and logical reason.

According to report, Nigeria daily fuel consumption na controversial topic for long. However, in September last year, di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority insist say di kontri dey consume 66.8 million litres of petrol daily.

Remember say upon di emergence of President Bola Ahmed Tinubu, hin declared di removal of fuel subsidy removal. Di announcement lead to upward adjustment of petrol pump prices from N195 per litre to over N577 per litre.

You fit go read di tori as NEITI take steps to investigate fuel consumption…READ MORE