fbpx
May 18, 2024

New Naira Notes: Pressure On CBN To Extend Jan 31 Deadline Don increase

pressure-on-cbn-to-extend-deadline-don-increase

Governor Abdullahi Umar Ganduje of Kano State, di Northern Elders Forum (NEF) and di Muslim Rights Concern (MURIC), and others, don follow put mouth for di extension of time or cancellation of the policy until the country dey ready. Di Pressure On CBN To Extend Jan 31 Deadline Don increase

All of dem make this call as di date for di anuary 31 deadline dey less than  three days. Pipo across di country don lament about di untold hardship over dia inability to access di redesigned naira notes from di banking hall or di Automated Teller Machines (ATMs).

 E dey reported say some some corrupt officials of di CBN and commercial banks don already dey plan with touts to ‘sell’ di new notes to pipo wey wan buy.

FOR MORE NEWS: Banks dey battle shortage of new naira notes ahead of deadline

For instance, for Damaturu, di Yobe State capital, pipo wey dey collect cash dey hang around banks collect N11,000 of old notes in exchange for N10,000 new notes.

One of di POS operators, Kabiru Isiaku, yarn say those money exchangers tell am make hin go mosque for hin area wey dey Hotoro and, hin bin dey among di first set of pipo wey reach there. But at di end, nothing good com out.

 Another trader for Hadejia, Jigawa State, Sajo Aliyu yarn ay this development na outright violation of wetin dem expected. He yarn say na true,  dem don bring something like mobile banking to exchange di money, but when go with N300,000 dem go only give you N10,000 of new notes and leave you with N290,000 of old notes.

Now wey banks still dey struggle with di new naira note, di Pressure on CBN to Extend di Deadline don increase.

 You  fit go read  di full tori…READ MORE