fbpx
April 19, 2024

Nigeria FA officials demands for 50/50 – Eriksson

0

Sven Goran Eriksson don accuse Nigerian football officials of asking to take half of hin salary before dem go give am di job of managing di Super Eagles.

Eriksson was in charge of Ivory Coast at South Africa 2010.

U FIT ALSO READ Man U: Hijack Bellingham before Man City,Liverpool go show face – Rooney

Di Swedish football coach who don manage top sides, both club and country, tok say hin bin dey di race to lead Nigeria to di first World Cup on African soil – South Africa,

But becos say hin refuse to dance to di tune of FA na di reason why hin miss di opportunity.

“After Nigeria lost dia semi-final game of di Africa Cup of Nations, di Nigerian FA con sack di team coach,upon say na four months remain for World Cup to start.

In order to bring in a European replacement. Like many other African countries,dey invite me to con take di job.

Eriksson tok say hin fly to Abuja, Nigerian capital, to meet di Nigerian FA and negotiate di job as Nigeria manager.

Although hin know say Nigeria FA don show interest for di coach of Egypt national team, but hin assume say na him suppose collect di job.

Eriksson tok say“hin meet with di FA officials for Hilton Hotel inside Abuja.
Inside di meeting room, na ten pipol dey inside dat room as if say na panel, and dey con dey ask am stupid questions.

”After di meeting for Abuja,Eriksson tok say di Nigerian officials tell am say dem go share hin salary with am 50/50 na di reason why hin reject di job.”

Hin con tok say assuming hin know say na like dat dem go do hin for no show up at all.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *