fbpx
May 9, 2024

Stock market open September with N536bn gains

stock-market-n536billion-gain

Upon say pipo worry dey about inflation wey dey increase everyday, interest rate hikes and weak macroeconomic indices, positive investors’ belief for di stock market last week drive N536billion gain for di Nigerian Exchange Limited, NGX, for di beginning of di month (September) trading on Friday.

Di market wey open for N36.422 trillion, maintain upward direction, and e close for N36.958 trillion, and dat one show 1.47 percent capital gains.

Also, di All Share Index (ASI) move up by 1.47 percent to 67,527.19 points from 66,548.99 points.

Dis one bring di cumulative gains for di week to N1.077 trillion or 3.00 percent Week-to-Date (WtD) returns.

 

FOR MORE NEWS: Devil don capture pipo wey dey do liposuction surgery – MFM founder, Olukoya

 

All dis one dey come as African markets, website wey dey track di performance of stock exchanges for Africa, name di NGX as one of di best performing exchanges for Africa in di last three months.

According to di report, Ghana Stock Exchange (+22.84%) appear as first, followed by di Nigeria’s NGX (+19.33%) while Malawi Stock Exchange rank third with +15.79% returns.

Investors don strategically positioning themselves and dem dey take advantage of di recent record earnings wey di firms quotes.

You fit go read di tori see as di Stock market drive N536billion gain…READ MORE