fbpx
April 27, 2024

Nkechi Blessing throwback photos -Her Fans no believe am

Nkechi-Blessing-throwback-photos

After fans and followers of Nollywood actress, Nkechi Blessing Sunday, see throwback photo wey she share for her post, dem dey wonder weda na she be that. She no resemble that throwback photo at all. Her fans and followers sef dey wonder weda she dey whine dem. Nkechi Blessing throwback photos na hin dey make internet pipo dey tok now.

Na that same epic throwback photo of di controversial actress dey make her fans and followers dey tok since.

For di caption of her throwback photo, Nkechi tok say her transformation na product of growth, grace and glow.

GROWTH, GRACE AND GLOW”.

Inside di comment section of that post, some fan thank God for Nkechi life, say God do well for her. Other fans and follower dey wonder which kain transformation make her kon get big backside now.

FOR MORE NEWS: No be person go tell me my age, I no hurry – Erica

E be like say, for Nkechi Blessing throwback photos, nothing bin dey for di backside. Na part of wetin dey make some followers dey tok about di matter.

One Precious Uche, wey dey doubt say na di throwback photo yarn say hin no believe am. Hin feel say that throwback no be Actress Nkechi.

Another person with di username Laura write, “Thank God we no resemble wetin we don experience for life.

Jennifer Leonard write, “Where di yansh and di hip come from?

One Ricardo prinzz write, “Something still dey baffle me about this ur pictures. Abeg na how manage u take get that yansh because from that old pic u be lepa with flat yansh

You go like go read di full tori…READ MORE