fbpx
April 28, 2024

No be person go tell me my age, I no hurry – Erica

No-be-person-go-tell-me-my-age-I-no-dey-hurry

Erica Nlewedim don open up say she go soon clock 27, and she neva ready for marriage. “No be person go tell me my age, I no dey hurry”, Na wetin Erica tok be that.

She be one of Big Brother Naija Lockdown ex-housemate wey bin dey disqualified.

This tok na di actress response to one of her fan wey ask her weda she no wan marry.

On top that one, she still tok say na only men dey enjoy for marriage because they dem no dey change plenty things about dia lives.

Erica tweet say she go clock 27 this year and no be person go tell her di age wey she dey.

She yarn say wetin be di need to rush when she get di rest of her life to dey married. Na men dey enjoy marriage because dem no go really change much about dia lives but na plenty things woman dey change.

Erica write say since she comot for BBNaija, he dey working, singlemindedly; almost like robot. She just dey focused on ger goals, and she dey try make everybody around her proud..

She yarn say na real struggle anytime wey she think back to those moments of fear and sadness,  but she don promise herself say she go dey proud of herself.

No be person go tell me my age, I no hurry – Erica

You go like go read di full tori…READ MORE