fbpx
May 4, 2024

Subsidy: NLC shun FG meeting, electricity workers back strike

nlc-shun-federal-government

Di Nigeria Labour Congress, NLC on Sunday shun di meeting wey Federal Government call to discuss di subsidy removal and hike in fuel pump prices across di kontri.

Also, di union insist say dem no go hold any dialogue with di government representatives unless a legitimate team dey set up.

However, di Trade Union Congress officials attend di meeting and na follow-up to di talk wey dem hols with NLC for di Presidential Villa, Abuja, last week.

 

FOR MORE NEWS: FG go fix date for national census – NPC

 

Di electricity workers vow say dem go join di strike and dem go put di nation inside blackout for protest against di removal of fuel subsidy by di Bola Tinubu administration.

Also, di National Treasurer of di NLC, Hakeem Ambali, confirm di decision of di union to boycott di meeting wey be follow-up to di Wednesday meeting on di removal of subsidy.

You fit go read di tori as NLC shun Federal Government…READ MORE