fbpx
May 5, 2024

NNL go train 40 coaches ahead of new season

nnl-plans-for-training-programme

Di Nigeria National League, NNL board don conclude dia plans for training programme for all di coaches wey dey di division.

Also, di Chairman of di NNL, George Aluo make di announcement during courtesy visit to di National Institute for Sports for Lagos.

Mr Aluo yarn say di training na to upgrading di knowledge of all di 40 coaches in order to boost di standard of di league.

 

FOR MORE NEWS: EPL: Hojlund don ready to make Man Utd debut after £72m move from Atalanta

 

In addition, di NIS boss Professor Olawale Moronkola give assurance say dem go provide the best expertise to make di training a success.

Also, hin pledge di support of di institution for di league ahead of di upcoming season.

Di 2023-24 season dey expected to kick off in September.

You fit go read di tori of NNL plans for training programme…READ MORE