fbpx
May 8, 2024

NNPP dey blame Kwankwaso as tribunal sack Kano gov

nnpp-dey-blame-kwankwaso

Shey you hear say di New Nigeria People Party, NNPP dey blame former presidential candidate of di party, Rabiu Kwankwaso say na im dey responsible for di loss of Kano governor, Yusuf Abba for di State Governorship Election Petitions Tribunal.

Di party strong mouth tok say Kwankwaso sell NNPP to di ruling All Progressives Congress so dat im go fit negotiate for ministerial position for di President Bola Tinubu-led government.

On top dat one, Kano State Governorship Election Petitions Tribunal on Wednesday, sack Abba, and dem declare di APC candidate, Nasir Gawuna, winner of di March 18 governorship poll.

In addition, di three-man panel, wey Justice Oluyemi Akintan-Osadebay lead follow withdraw di Certificate of Return wey di Independent National Electoral Commission bin give Yusuf.

 

FOR MORE NEWS: Again, national grid collapse five days after restoration

 

Also, as di panel dey tok di reason why dem sack di Kano governor, dem tok say di margin of votes wey NNPP score dey invalid and e no dey in compliance with di 2022 electoral act.

Di judges deduct 165,663 votes from di NNPP, and dem add say di ballot papers of di165,663 no get stamp signature and na why dem declare am invalid.

Reacting, One of di Chieftain of NNPP for Southwest, Alhaji Abass Akande Onilewura, inside statement on Thursday, tok say di loss of di party for Kano confirm di anti-party allegation against Kwankwaso.

NNPP dey blame Kwankwaso, You don see di tori…READ MORE