fbpx
April 25, 2024

UTME: JAMB dey advise against indecent dressing

0
UTME-

As 2023 Unified Tertiary Matriculation Examination and Direct Entry Examination go soon start, di Joint Admissions and Matriculation Board don issue advisories against di use of henna wey people dey call  “laali”, bogus jewelry, outrageous outfits among others, The PUNCH has learnt.

Di board take di decision after dem observe say that kind of dressing and decoration for body dey bring distractions for examinations wey dey organized by the board.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

Di board still yarn say, “Henna wey girl dey put for finger dey obstruct di smooth biometric verification of di candidate fingers. When di candidates wan clean their fancy henna drawings, dem go dey use chemicals wey fit damage di whorls for their fingers, na that one go kon make biometric verification and authentication hard.

“The Board still stand for their position of “No Biometrics, No examination rule” and dem advise candidates make dem avoid any act wey fit jeopardise their chance to write di UTME.

This tori dey for Punchng…READ MORE

For more news: Unemployment Mattar, Make una stop certificate discrimination – ITF DG clear FG

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *