fbpx
May 6, 2024

Obi Yarn Big Congrats to Osimhen, Oshoala & Co for CAF Awards

obi-congratulate-osimhen-Oshoala

Labour Party presidential candidate, Peter Obi, don congratulate Victor Osimhen and Asisat Oshoala for dem win as African Players of the Year for 2023, for men and women categories respectively.

Former Anambra State Governor still carry eye congratulate Chiamaka Nnadozie wey win 2023 Confederation of African Football Women’s Goalkeeper, and the Nigerian Female football team.

For tweets wey Obi drop for hin X handle on Tuesday, Obi talk say, “I like join all the sports lovers for the country to sincerely congratulate the Nigeria duo of #victorosimhen9 and #AsisatOshoala for emerging African Players of the Year, for men and women categories respectively this year.

 

FOR MORE NEWS: Naija People Dey Suffer: Naira Scarcity Waka Nationwide

 

“I still celebrate #Nadoziechiamaka wey win the 2023 CAF Women’s Goalkeeper of the Year Award and our Nigerian female football team, Super Falcons, wey win the 2023 CAF award for the National Team of the Year.

“We dey proud of their awards, wey show say them get talent, passion for growth, and determination for success.

“My sincere desire be say every Nigerian youth go get the enablement to explore and develop their talents and skills, fit live to fulfill their dreams, and by so doing, fit contribute to the development of our nation.”

You fit go read di tori see as Obi Congratulate Osimhen and Oshoala …READ MORE