fbpx
May 3, 2024

AFCON 2023: ‘Super Eagles dey ready to tackle any team’ – Simon.

super-eagles-don-secure-their-place

Super Eagles of Nigeria show class as dem secure their place for di Round of 16 with one impressive 1-0 win against Guinea-Bissau for di Felix Houphouet Boigny Stadium for Abidjan on Monday.

Di moment wey carry di day happun for di 36th minute as Opa Sangante accidentally carry leg score from Simon’s correct cross. Dis win e mean say Nigeria don move to di next stage for di ongoing AFCON 2023 tournament.

Simon, wey be one of di heroes for di match, talk say, “E good for us as we fit waka comot from di group. E dey important for us.

 

FOR MORE NEWS: Kcee win 11.7 million naira bet as Super Eagles knack Ivory Coast for AFCON 2023

 

As dem dey reason di next match for Round of 16, Simon talk say dem no dey pick any team wey dem wan face. E yan say, “We no dey think of di team wey we go jam for di next round. I fit talk say we no get any team wey we dey look say we wan play. We gats dey ready for any team wey show face. If we wan carry di trophy, we gats dey ready for any team.”

Super Eagles go siddon dey wait make Group F finish dia matches so dem go sabi di team wey dem go waka enta pitch against for di next level. But for now, dem focus dey dey on top to make sure say dem dey ready well-well for any team wey show, as dem dey eye di trophy wey dey di tournament.

You fit go read di tori, Super Eagles don secure their place…READ MORE