fbpx
May 3, 2024

UCL: Petit yan say make Arsenal shine eye on dangerous RC Lens star

emmanuel-petit-warn-arsenal

Ex-Arsenal player, Emmanuel Petit, don warn say make Arsenal shine their eye on top one ‘wahala’ player for RC Lens squad wey dem go play for UEFA Champions League on Wednesday night.

Arsenal dey go into the Group B clash, and dem don win three out of their four games so far. If Mikel Arteta’s side no lose for the match against French Ligue 1 side, dem go qualify for the Champions League last 16.

Petit believe say Lens striker Elye Wahi fit worry Arsenal for Emirates Stadium.

 

FOR MORE NEWS: “Withheld salaries: Uncertainty dey ground as ASUU no gree accept FG offer.”

 

“Lens get beta result for weekend, as dem knack Clermont Foot 0-3,” Petit yarn Lord Ping. “Dem dey show sign of the team wey surprise plenti people for France last season.

“Arsenal no dey easy to beat for house, but if Lens fit play with the same spirit wey dem take play for opening group game, dem fit cause problem for Arsenal. For football, if you get chance, you gats use am.

“Elye Wahi, wey be Lens striker, score for weekend, and e be player wey fit wound Arsenal. Na player wey Arsenal gats dey look because e get quality wey fit wound dem.”

You fit go read di tori as Emmanuel Petit warn Arsenal…READ MORE