fbpx
May 18, 2024

“If I marry and my husband cheat, I get access to slow killer poison” – Pharmacist don tok

Pharmacist-say-she-get access-to-slow-poison

One young pharmacist wey dey identified for Facebook as Claire Anuh don make pipo dey tok after she yarn say she get access to slow poison and she go kill her husband if he cheat on her.

Di pharmacist take to her Facebook page to reveal say since she be pharmacist, she get access to any kind of slow poison drug wey fit slowly kill person.

 

FOR MORE NEWS: CBN move to collect bank consumers’ data no dey necessary – NDPB

 

Explaining further, di pharmacist tok say if her husband cheat on her with another woman, she go behave innocently and she  no go give am any reason to suspect her and begin to poison hin food and drink with di slow poison wey go gradually kill am without trace.

She add say she don sell those slow poison drugs to some women and nobody suspect dem of killing their own husbands.

You fit go read di tori…READ MORE