fbpx
May 6, 2024

Old Naira Notes Rejection: CBN Dey Warn Market Women Make Dem No Reject Old Naira Notes.

cbn-don-reduce-new-naira-allocation-

As di deadline for old naira notes transaction dey near, CBN don sound warning to market women. Di Central Bank of Nigeria (CBN) don warn market women and traders for Bauchi say make Old Naira Notes Rejection neva dey dia agenda until di end of this month.

Old Naira Notes Rejection no suppose dey dia mind now until time reach. Idris Andaza, di branch controller of CBN Bauchi, tell di traders for Wunti market say make dem carry all dia old naira notes go bank.

As hin dey sensitize di traders, e remind dem of di 31st  January 2023 deadline wey di note go dey accepted a legal tender. After that deadline, na new naira note go be di only legal tender.

FOR MORE NEWS: CBN dey under pressure to shift Jan 31 deadline

Until that time, new and old notes still be legal tender. Just like dem announce, na di N200, N500 and N1000 notes na hin go change as legal tender after di deadline.

Still on di matter of Old Naira Notes Rejection, Idris Andaza advise marketers wey get habits of keeping dia money for shop say make dem quickly carry everything go any commercial bank, deposit.

All di commercial banks don collect order to collect di old notes without charging customers. All these things na wetin di branch controller follow marketers yarn.

You fit go read di full tori…READ MOREOld Naira Notes Rejection no suppose dey dia mind now until time reach.