fbpx
May 4, 2024

“Dem don spoil Father’s Day finish”- Paul Okoye send message to Tonto Dikeh, Ini Edo, others

paul-okoye-warn-female-celebrities

Paul Okoye, wey be Nigerian artist and di other half of di well-known music duo, Psquare, don warn female celebrities wey portray themselves as father figures.

Paul criticize how dem reduce di significance of Father’s Day on top hin Instagram story.

Hin yarn say hin dey looking forward to di day wey one man go celebrate himself on Mother’s Day by posting a photo of himself with hin pikin.

Also, hin lament as hin see how some mothers dey dragging Father’s Day along with them.

 

FOR MORE NEWS: “E don reach 10 months since I see my pikin” – Do2dtun lament as hin call out ex-wife

 

“Just waiting on the day a man will post himself with a child on Happy Mother’s Day. Small Father’s Day wey we just dey manage. Aswear dem don spoil Father’s Day finish”.

Dis tori dey come after after pipo like Ini Edo, Tonto Dikeh, Ruby Ojiakor, others celebrate themselves on Father’s Day.

You fit go read di tori as Paul Okoye warn female celebrities…READ MORE