fbpx
April 26, 2024

Person shoot American rapper Takeoff for Houston, e don kpai.

0
Take-off-shot-dead-

American rapper, Kirshnik Ball wey dey popularly known as Takeoff,  member of di hip hop trio, ‘Migos’ wey include di Quavo and Offset, na hin dem shoot for Houston, now hin don kpai.

TMZ report say Takeoff and Quavo bin dey play dice for di bowling alley when loud argument start and person kon start to shooting, na so one of di  bullet touch Takeoff.

YOU GO LIKE READ: Avoid These Top 10 visa Rejection Reasons

Di fatal incident happen early Tuesday morning and na for that scene dem announce say hin don kpai.

Inside some series of tweets, di Houston police confirm di incident but dem no give di identity of di person wey kpai.

Di tori dey inside Punch, click here make you go read di remaining…READ MORE

For more News: Wizkid don delete hin album promotion tweet after death of Davido pikin

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *