fbpx
April 25, 2024

Why I arrange make dem kidnap my husband.

0
Map\of\Akwa-Ibom

Akwa Ibom Police Command arrest one 40-year-old woman, her name na Mrs Joy Sunday. Dem arrest her because she plan make dem kidnap her husband. Na on Friday she open up tok say na she be the master planner of di kidnap and she follow tok why she do am.

She tok say she help the kidnappers kidnap her husband because her husband no dey gree sleep with am for house and hin no dey give her money for house and this matter don dey happen since.

Di information wey dem don get be say di kidnappers dey ask for N10m as ransom but later dem reduce am to N2m wey dem pay before police kon arrest dem as dem wan dey share the money.

 

You fit like read this one: Lagos Police arrest singer Ice prince on top assault

 

The suspect, wey dey among 29 other march for plenty offence including kidnapping, robbery and child theft by the State Commissioner of Police, Olatoye Durosinmi, she tok say she don dey do different hand jobs to takee get money for herself and the children since her husband go marry another woman.

She say, when one of her pikin finish secondary education, money no dey wey hin go use continue school go university.

She say, “she arrange for her husband kidnap because, he abandoned her and dia pikin. Even when her father and mother inlaws dey alive he abandoned her. He no care for hin children.

She say she dey do work like to weed people farm so that she go fit feed her children and pay their school fees.

Rush CLICK HERE make you go read the tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *