fbpx
May 18, 2024

Portable and hin big sister sustain injury after pipo attack dem for bar – VIDEO

portable-and-sister-after-attack-for-bar

Controversial Nigerian singer, Portable don make am to headline news again for di umpteenth time after him and hin big sister sustain injury after attack for bar.

Di Zazuu Crooner take to hin Instagram story to share series of photos and videos on top hin Instagram stories after di attack.

Inside one of di photo wey dey hin page, hin sister dey bedridden for hospital. According to Portable, some pipo wey hin call  Oke Osa Boys na hin dey responsible.

FOR MORE NEWS: “I am consistent; you can call me Peter Jr.” – GRV don open up on how Peter Obi inspire am

Di matter no stop there, Portable explain say these pipo bin dey fight hin sister. Also, na because of di matter hin cut short hin Zambia trip return go house. Dis na so dat hin go fit defend her.

Also, Portable show di injury wey him and hin sister sustain after di attack. In addition, hin mention say one of hin childhood friend wey hin dey help follow stab am for neck.

He show injury wey dey hin head and he claim say hin buy bike for di person wey do am dat kain thing. And hin no collect shishi from di guy.

You fit go read di full gist…READ MORE